Monday, May 23, 2016

Maga Don pay: United come give Mourihno £4 mila to wait make them sack Van Gaal

Tori don dey shele wey talk say Man U don sack Louis Van gaal come crown Jose Mourihno as their coach. E be like say Man U come pay Jose £4 milla just to sit don dey wait as Man U dey sack Vangaal. This world get as e be. Dem no no Van Gaal win FA Cup?

Sunday, May 22, 2016

Granit Xhaka don dey waka go Arsenal

Borussia Mongladbach midfielder don set to move to Arsenal. The 23 year old go dey take £110k per week. Hmm. E be like say Wenger wan win league.